text
stringlengths
19
2.51k
as kasala dey increase for nigeria, especially for northern part of di kontri, wia unknown gunmen, boko haram/iswap, bandits, herders and farmers dey clash, di place wey dem also sabi for big farming don dey face serious palava.
as rainy season dey try reach im peak, farmers dey fear to go farm becos dem no wan risk dia life or make bandits kidnap dem.
for recent weeks, kasala wey happun for north east, north west and north central don claim many lives and properties. dis areas na places wey dey produce plenty food for nigeria.
recently, ministry of agriculture for nigeria release one internal memo wey tok say make dia staff fast for three days sake of food wahala for di kontri. dis move show how serious di mata be.
for 2024 alone, world food program report say kasala, insecurity, inflation and climate wahala go make hunger worse for nigeria, and say 26.5 million pipo go face serious hunger.
national bureau of statistics (nbs) tok say food inflation rate for october 2024 na 39.16% compared to 31.52% for october 2023. experts believe say insecurity na one of di major reasons wey cause dis kain inflation.
experts still tok say goment need to do more to fight insurgency or find modern farming ways becos farmers for north dey fear to go farm.
secretary of all farmers association of nigeria (afan), dr yunusa halidu, tell bbc pidgin say insecurity na one of di reasons wey dey cause food wahala and food inflation.
before dis insecurity wahala, many states for north dey farm plenty food, and food dey cheap for market," oga halidu tok.
if no be for insecurity, zamfara alone fit feed di whole kontri afta harvest.
e believe say na insecurity cause di food inflation wey nigeria dey face.
lack of food na one of di reasons why food price rise for recent years, and na insecurity cause am. you know say di more pipo dey need sometin, di more di price go up," e tok.
e mention say some northern states dey produce rice, wey nigerians dey chop well - well, but rice and oda food production don reduce.
states like borno, yobe, katsina, zamfara, sokoto and kebbi sabi farm rice, but sake of insecurity, dem dey produce small rice now.
halidu add say "na only jigawa for all di northern states dey farm witout security wahala, sake say bandits no too dey dia.
e still tok say if federal goment fit solve insecurity and provide farming support, nigeria no go get food wahala and food go cheap for evribodi.
dr angarawai ijantiku ignatius wey sabi farming well - well and be country representative for international crops research institute for semi - arid tropics (icrisat) for kano, tell bbc pidgin say federal goment need to embraced and invest for modern farming.
but no mata di modern innovation, we still need land. but for small scale, we get wetin we dey call homegrown food.
pipo fit use bucket or cement bag put soil and plant yam, pepper or onion for house. e fit feed family of two or three.
e tok say anoda modern way na make goment provide community - based place wey farmers fit plant and harvest.
we get new technology wey we dey call community - based farming programme, wia we go give farmers free training on di new method.
how dem fit farm and harvest quick and distribute am for community," dr ignatius tok.
but for dis one, we need community vigilante to protect farmers.
e also tok say dem suppose dey help farmers get fertiliser by using compost, since some places bandits no dey allow dem go outside village.
but e still tok say homegrown food na just support, e no fit reach evriwia.
on di oda hand, anoda expert wey sabi security mata for kano, dr auwal abdullahi, tok say nigerian goment suppose try anoda way to fight insurgency.
e tell bbc pidgin say for over 10 years, goment dey use force fight insurgents, but e suggest say make dem try dialogue.
make goment understand and work wit security pipo, community and gada intelligence.
for farming season, goment need to work wit community and if possible, negotiate wit bandits" im tok.
e say dis method work for birnin gwari local goment for kaduna state.
dr abdullahi also tok say if dem use peaceful method to tok to bandits make dem drop arms and stop banditry, kidnapping and cattle rustling, farmers go fit go farm and e go help nigeria economy grow.
nigeria don announce dia squad for dis year women africa cup of nations, wafcon. di squad include several key players, like captain rasheedat ajibade, goalkeeper chiamaka nnadozie and forwards francisca ordega and asisat oshoala.
morocco go host di 13th edition of wafcon wey go start from july 5 - 26.
di best women footballers for africa go gada for di north african nation to compete for di ogbonge trophy.
south africa na di current holders but dem go face oda nations wey dey eye di crown.
di confederation of african football, caf, put di 12 competing qualified teams inside three groups.
hosts morocco dey group a wey get zambia, senegal and di democratic republic of congo, while 11 - time winners nigeria dey di same group wit botswana, tunisia and algeria.
south africa go begin di defence of dia title for group c against ghana, mali and tanzania.
bayana bayana drop former women footballer of the year, thembi kgatlana from dia squad.
most teams go announce dia final 23 - player squad on 23 june.
already, nigeria football federation don secure friendly matches for di team wit di senior women national teams of portugal and ghana, to put dem in a competitive mood ahead of dia group b encounters against tunisia, botswana and algeria for di larbi zaouli stadium for casablanca.
super falcons go up against dia portuguese counterparts for lisbon on monday, 23rd june, bifor dem go play di black queens of ghana for morocco on sunday, 29th june.
on thursday, di lawyers of nnamdi kanu, leader of di indigenous people of biafra (ipob), tok say dem go file a no - case submission over di terrorism charges wey di nigeria goment sama on am.
dem tok dis one afta di federal goment close dia case for di trial afta dem don call five witnesses and tender plenty documents as exhibits including video and audio broadcasts wey dem say kanu bin make.
nigeria goment dey try kanu on terrorism allegations. dem say e terrorise pipo by issuing illegal sit - at - home orders, and by telling im followers to attack and kill police.
kanu plead not gulity to di charges.
dis na di summary of how di matter take reach dis stage since justice james omotosho take over from justice binta nyako:
di matter start afresh on 21 march, 2025 as di nigeria goment re - arraign kanu on seven counts of terrorism, belonging to a terrorist group, and illegal importation of radio equipment. kanu plead not guilty.
on dat day, our tori pesin wey don dey cover dis trial since 2019, notice say kanu don change im lead counsels and employ ogbonge senior advocates like di former attorney general of di federation and minister of justice, kanu agabi; onyechi ikpeazu, emeka etiaba, paul erokoro and so.
bifor dis time, kanu lead counsel na ifeanyi ejiofor and aloy ejimakor, and later mike ozekhome (san) join dem for some time bifor dem withdraw am again.
on di day of re - arraignment, kanu agabi apologise to di court for how nnamdi kanu bin para for justice nyako and di fg lawyer, adegboyega awomolo during di previous hearings.
justice omotosho accept di apology as e tok say e understand say di defendant bin tok out of anger sake of say di case don last for ten years now.
as i dey look di case file, i see say dis matter start wen di defendant dey 45 years old, now e dey 55 years, so i understand im anger. dat na why i go grant accelerated hearing for dis matter," omotosho tok.
for di next adjourned date - 29 april, 2025, di nigeria goment call dia first prosecution witness, mr aaa (no be im real name).
all di goment witnesses testify using codenames aaa to eee for di five witnesses, sake of say dem dey work wit di department of state services (dss), wey be nigeria secret security outfit. di court also permit dem to testify behind cover and for dem to also wear mask.
mr aaa na di officer wey lead di arrest of nnamdi kanu for 2015. dem arrest am for one hotel close to di lagos international airport.
di witness tok say dem arrest kanu wit one woman for im room, and dem recover plenty broadcasting equipment for im hand, but during cross - examination, e confirm say dem no find any terrorism equipment wit am.
e tender videos of statement wey kanu bin make for di dss headquarters in abuja afta dem transport am from lagos. for dat video, im lawyer aloy ejimakor and one oda lawyer dey dia.
di witness also tender in evidence two boxes containing kanu personal belongings like shoes, wrist - watches, and perfumes, plus some broadcasting equipment like microphones, tripods, laptops, ipads, and internet modems.
di second prosecution witness - mr bbb start im own testimony on 7 may, 2025.
e tok say im na one of di lead officers wey investigate nnamdi kanu, afta di den agf abubakar malami, write a petition to dss complaining of di broadcasts wey di ipob leader dey make on social media using radio biafra.
dis witness tender video evidence wia nnamdi kanu announce di creation of di eastern security network (esn), and wia e threaten bola tinubu and say e go destroy im properties for lagos.
mr bbb also say dia investigation show say nnamdi kanu broadcasts dey directly connected to di violence and killings wey dey go on for di southeast region.
e also tender as exhibit, di death certificate of ahmed gulak, wey be chieftain of di all progressives congress (apc) wey jaguda pipo bin kill for owerri imo state on 30 may, 2021.
di witness claim say na ipob fighters kill gulak sake of say e disobey di sit - at - home order wey kanu bin give for dat may 30 - a day wey ipob dey mark as biafra remembrance day.
during cross - examination, bbb deny say no be dss pipo arrest kanu for kenya. e say dia work no dey cross outside nigeria.
also, kanu lawyers tender video evidence of di govnor of imo state as e tok say ipob no dey responsible for di killings for di state, rather na politicians dey do am.
dem also play videos of retired major general for di nigeria army, t.y danjuma, and di current director - general of di dss adeola ajayi wia dem dey tell di public make dem rise up and defend diasef from terrorists and bandits
dis witness na also one of di officers wey bin investigate kanu wen dem arrest am from 2015.
e tok say im and two oda dss officers bin interview kanu on october 21, 22, 23 and 24, and again on november 4 of dat 2015, and e present di video recording of dat interview to be tendered as evidence.
however, one of nnamdi kanu lawyers, paul erokoro inform di court say kanu tell am say im bin dey under duress wen e make di statement.
prosecution lawyer say no be true, say kanu make di statement voluntarily witout any force.
to determine weda to accept di video in evidence, justice omotosho order for trial within trial.
dem play di video for court and e show say kanu bin complain several times say e dey entitled to a lawyer but di dss no wan give am im lawyer.
justice omotosho rule say e no go admit di evidence bicos e go against di evidence act wey clearly state say a defendant must to make im statement in di presence of im legal representative.
i hereby order as follows: dat di statement of di defendant dated 21 to 24 october and november 4 2015 dey inadmissible in evidence.
dat di video recordings of di statement wey i bin don admit and marked pwq and pwr, also dey inadmissible and hereby marked rejected," omotosho tok.
anoda dss officer, dis witness say e work for di imo state command between 2019 and 2022, and na im lead di team wey recover di radio transmitter wey kanu bin allegedly import into di kontri illegally.
oga ddd say dem use ogbonge technology to geolocate one video wey kanu bin make wia e tell im followers say dia radio transmitter don land.
e say dem locate di equipment for ubuluisiuzor community, for ihiala local goment area of anambra state, for di compound of one benjamin madubugwu.
dem hide di transmitter inside di container and cover am wit household items like mattresses and washing machines, e tok.
dis witness also tell di court how one ipob/esn commander wey police arrest, bin confess say nnamdi kanu order dem to bury one of dia commander wey police kill wit 2000 human heads, but na 30 pipo dem don get so far bifor police arrest am.
according to ddd, dis arrested ipob member name na uzoma benjamin, a.k.a 'onye army. however, e admit say no be im interview di suspect, but na wetin di newspapers publish.
di witness tender a publication of vanguard newspaper of 3 july, wey contain di report.
e also tok claim say na ipob kill ahmed gulak bicos e disobey sit - at - home order wey nnamdi kanu bin declare.
however, during cross - examination, one of kanu lawyers onyechi ikpeazu, point out say gulak na politician, and na im be di chairman of di primary election wey produce uzodinma as di apc govnorship candidate for imo state.
ikpeazu ask di witness why e be say di killers kill only gulak, but dem no touch di driver of im vehicle and di oda passenger wey dey wit am dat time, since na all of dem disobey di sit - at - home order.
e also point out say di govment of imo state later come out to explain say di killing of gulak dey politically motivated.
dis last witness tell di court say im work na to investigate wetin happen during di end sars nationwide protest of october 2020 for nigeria.
eee insist say di issue of police brutality na di secondary cause of di protest, but di underlying reasons na bicos say some subversive elements, like nnamdi kanu, bin don dey incite di public against di goment.
e tender document of dia investigation as evidence, and di document show say about 175 security officers - including policemen, army pipo and dss pipo - bin die across di kontri during di protest.
for di cross - examination, ikpeazu ask di witness say: shey you dey categorically tell di court say di end sars protests na biafran issue?
di witness respond say "my assignment no be to investigate biafra, my assignment na to investigate di end sars protest to which di defendant bin incite di public.
ikpeazu den point to di report of di panel of enquiry into di end sars protest for lagos state, and say di report no mention ipob or nnamdi kanu anywia as di pipo wey dey responsible.
e also try to poke holes for di document wey mr eee bin tender, as e point out say di document no get di signature or stamp of di pipo wey claim say na dem write am.
also ikpeazu point out say di document get inconsistencies, like wia e refer to osun state as ekiti state, and places wia details of di dead bodies of di security pipo wey dem claim say ipob/esn pipo kill durin end sars no dey clear.
as cross - examination end, awomolo, counsel to di goment inform di court say dem dey close dia case for hia, as dem believe say di evidences dem provide and di witnesses dem call don dey sufficient.
kanu agabi, di lead defence counsel inform di court say dem go file no - case submission, since di prosecution don exhaust dia case.
chief awomolo get di misfortune of trying dis case, and we get di misfortune of defending am, bicos we no see any case at all for dis charges against our client," agabi tok.
e ask di trial judge to give dem some days to file dia written address on di no case submission.