text stringlengths 19 2.51k |
|---|
justice omotosho grant di defence team 14 days to fille dia written address, and also 14 days to di prosecution team to file dia own. |
omotosho adjourn di matter to 18 july, 2025, for di two sides to come and adopt dia addresses so dat e go rule, perhaps afta judges come back from dia annual vacation wey dey start from late july to early september. |
since 2015 wen di nigeria goment first arrest nnamdi kanu, na only april dis year im trial start well - well. |
remember say di matter bin dey bifor justice binta nyako of di federal high court abuja, and na she bin grant kanu bail on health grounds in 2017, but kanu run for im life comot for nigeria afta soldiers bin carry out security operation for im house in umuahia, abia state for southeast nigeria. |
in june 2021, security pipo for kenya arrest kanu and carry am by force come bak to nigeria to face trial. |
di initial charges against di ipob leader bin dey 15, but justice nyako bring am down to seven. |
even though di court of appeal later strike out all di charges and discharge kanu, di supreme court reinstated di seven charges as dem tok say di ipob leader get questions to ansa. |
authorities for anambra, southeast nigeria, don confam say unidentified gunmen do shooting wey kill pipo and injure some for oko community for di state on thursday night. |
police tok - tok pesin for di state tochukwu ikenga for statement say di incident na cult clash and add say na two pipo die from di incident. |
however, local reports say at least five pipo don die while some dey for hospital dey collect treatment. |
videos wey bbc news pidgin sight show at least seven pipo on di ground wit wetin resemble gun shot injuries. |
di incident cause major kasala all over di community as plenti pipo scamper to safety. |
one lecturer for di school wey speak to our reporter and wey no want make we mention im name, say di attackers kidnap two lecturers of federal polytechnic, oko, wey dey within di community. |
e also confam say one staff of di polytechnic dey for hospital dey receive treatment sake of gunshot injury. |
chijioke ibeziako wey be di tok - tok pesin of federal polytechnic, oko, tell bbc news pidgin say di incident no happun inside di school, say na within di host community e happun. |
we don confam say di pipo dem kidnap na lecturers, we dey sure of one. di victims of di shootings no be students," na so e tok. |
e say kidnapping issue na somtin wey don dey ravage evriwia across di kontri. |
similar cult - related incident happun for october 2024 for nibo community wia ova ten pipo die from gunshot wounds. |
dis latest incident dey happun few months away from di state govnorship election wey go happun soon. |
oko community dey few kilometres away from di hometown of di sitting govnor charles soludo wey come from isuofia community. |
dis incident dey happun as nigerians still dey mourn di pipo wey lose dia lives for benue state attack, wey bin lead president bola tinubu to set up committee to stop di killings. |
as israel and iran continue to exchange strikes for dia latest conflict, several african kontris don begin make arrangements to evacuate dia citizens from both kontris back home. |
dis na on top fears say dem fit dey caught up for di middle of di fight - fight wey start on 13 june. |
goments of nigeria, south africa, uganda, ghana, and odas say dem don conclude plans to bring back dia citizens from di conflicts wey dey happun for di middle east. |
dis latest conflict start wen israel attack nuclear and military sites for iran, and iran too retaliate wit aerial attacks targeting israel. |
more dan 220 pipo don die for di israeli strikes so far, according to iran health ministry, while israel say iranian attacks don kill 24 pipo. |
for di latest wave of attacks wey happun overnight, iran launch one missile wey hit one hospital for beersheba for southern israel. |
israeli forces also say dem attack iran nuclear sites, wey include |
di number of pipo wey injure for di latest wave of strikes on israel from iran don rise to 89, according to israel emergency service magen david adom (mda), afta iran launch wave of missile overnight wey hit one hospital for beersheba for southern israel. |
israeli forces also say dem attack iran nuclear sites, wey include di arak heavy water reactor and di natanz uranium enrichment plant. |
nigeria tok say preparations to bring dia citizens home go soon complete and advise dia citizens to contact di nearest nigerian embassy or mission. |
di west african kontri say dem dey work wit international partners to fast track di evacuation. |
for statement wey di kontri ministry of foreign affairs release, e say: "di goment dey work wit relevant international partners plus local authorities to ensure di timely and secure evacuations of nigerians for affected areas. |
ghana goment say dem don begin di immediate evacuation of dia citizens from iran. |
for one state, di goment say dem don close di ghana embassy for tehran wit immediate effect to guarantee di safety of embassy staff. |
di evacuation through land borders cover all ghanaian diplomats, students, professionals, plus oda compatriots," dem tok for statement. |
meanwhile, for israel, ghana foreign affairs tok say dem neva fit comot dia citizens now becos israeli goment don close all di borders, and na only wit di express authorisation of israeli authorities dem go fit evacuate dia pipo. ghanaian authorities assure say dem dey pursue dose approval options. |
in di meantime, dem don advise dia citizens for israel to remain for bob shelters, until road clear to bring dem out. |
di foreign ministry add say ghana embassy for israel don identify 922 ghanaians wey currently dey live for israel. |
one ghanaian for israel kwabena amoateng (no be im real name) tok how dem dey keep safe for di kontri. e say, "life for here dey slow - but essential services dey work; supermarket, banks, hospitals dey work but oda offices no dey work. |
during di day, life na normal, di action dey happun at night. e fit start like 10 pm, 12 midnight some of di missiles fit drop like 8pm. sake of dis, we no fit to sleep beta," e tok. |
kwabena add say di israeli ministry of defense dey issue warnings whenever dem launch missiles, dem go inform dem say dem get 15 - 20 mins to run to di nearest bomb shelter |
dis information dey automatic on top evri israeli sim card so we dey get dis alerts. if dem launch for iran e dey take some time to reach israel. but if dem launch for here, we dey get dis alert on top our phones, wey mean say we gatz find bomb shelter. |
di second time di alert go come on top di phone, mean say di missile don dey near and den di siren go blow. |
dem bin open all di bomb shelters so if you hear di siren, you gatz rush to enta di nearest bomb shelter, e add. |
uganda don reach out to di middle eastern kontris neighbours for help in evacuating dia citizens, privately - owned chimp reports report. |
since di east african kontri no get any embassy for israel and iran, wey don close dia airspaces, dem dey coordinate evacuations through egypt, turkey, azerbaijan, and jordan. dem don ask di four kontris to grant dia citizens visas. |
di foreign ministry don ask diplomatic missions for iran and israel to facilitate di process, wit 48 students wey already dey on dia way out of tehran. |
kenya don ask dia citizens to "exercise extreme caution, avoid non - essential movement, stay indoors wen possible and follow local authority instructions". |
for di advisory, di ministry of foreign affairs issue, dem ask dia citizens to contact dia missions for tel aviv and tehran if dem require urgent assistance or dey for distress. |
south africa earlier don ask dia citizens for iran to register wit di embassy for dia safety. |
for statement, di ministry of affairs say dia support for iran dey limited and e dey possible say south african goment no go fit help if dem dey caught up for difficult situation. |
e dey important to note say south africa support for di kontri dey limited and face - to - face consular assistance no go dey possible in di case of emergency and di south african goment no go fit help you, if you get into difficulty, depending on your location. |
dem advise citizens to assess dia own safety and security and act accordingly. |
natasha akpoti - uduaghan wey be di lawmaker representing kogi central senatorial district for di national assembly don plead not guilty to di three - count charge of defamation, wey di office of di attorney general of di federation sama her. |
di lawmaker bin appear bifor justice chizoba orji of di federal capital territory high court for di maitama area of abuja on thursday. |
dis three - count charge accuse mrs akpoti - uduaghan of making false claims say di president of di nigeria senate, godswill akpabio, bin make plans wit di former govnor of kogi state, yahaya bello, to kill her. |
di agf say akpoti - uduaghan know say di claims na false but she make am to discredit akpabio and bello, and to tarnish dia image. |
as di matter come up for court, di court registrar read out di charges to di lawmaker and she plead not guilty to each of dem. |
afta dat, counsel to di federal goment, david kaswe, ask di court to remand di defendant in prison pending wen di trial go commence. |
kaswe claim say im reason be say dem wey be di prosecution bin find am very difficult bifor dem fit serve di defendant wit di charges. |
however, di defence counsel roland otaru, ask di trial judge to use her discretion and grant im client bail based on di fact say she no be flight risk, she no go fit interfere wit police investigation or wit di witnesses for di case, and di law presume her innocent until proven guilty. |
afta listening to di arguments, justice orji agree wit di defence counsel and say she go grant di defendant bail in di sum of 50 million naira and one surety. |
di surety must to get landed property within di jurisdiction of di court, and e must be a pesin of integrity. |
she den adjourn di matter to september 23, 2025 for di trial to start. |
some popular rights activists bin follow mrs akpoti - uduaghan come court to show am solidarity. dem include former minister of education oby ezekwesili, aisha yesufu and others. |
emmanuel uduaghan, di husband of di embattled lawmaker also follow her come court on thursday. |
bbc pidgin bin don report say dis na di fourth court case wey involve senator akpoti - uduaghan since late march dis year wen she get public quarrel against di senate president |
dis particular three - count charge na majorly about libel, two counts against akpabio and one count against yahaya bello. |
according to di charges, akpoti - uduaghan allege for interview say akpabio and yahaya bello bin meet for a hotel on march 14, 2025, wia dem emphasis say dem go kill her, but e no go be for abuja rather e go be for her state kogi. |
dat na one of di reason why i bin no go home on time. i bin delay to go home bicos i get to put some measures on ground," di charge sheet quote akpoti - uduaghan. |
also, di senator allege, according to di charge sheet, say akpabio and yahaya bello bin hold three discussions day. "di first one na my recall, di second one na to eliminate me, and di third one na to put somebody wey go take di ticket from me if i wan contest for 2027. |
according to di agf, mrs akpoti - uduaghan know or she get reason to believe say "dis imputations go harm di reputation of senator godswill akpabio, president of di 10th senate of di federal republic of nigeria", and di reputation of yahaya adoza bello, former govnor of kogi state. |
di third allegation for di charge sheet na during a two - way phone interview wey natasha akpoti - uduaghan allegedly do with one sandra duru for abuja, wia di senator bin claim say akpabio bin use di internal organs of one girl wey her name na umoren iniubong, for im wife who bin dey sick for three years. |
akpabio, bello, and one oda senator - asuquo ekpenyong - na some of di witnesses wey di agf say dem go call for di matter. |
lawyers to nnamdi kanu, leader of di indigenous people of biafra (ipob), don tok say dem go file a no - case submission on top di terrorism allegation wey di nigeria goment sama on top dia client. |
kanu agabi wey be di lead defence team for nnamdi kanu, tok dis one for court on thursday afta di federal goment counsel - adegboyega awomolo - inform di court say dem dey close dia case. |
for di hearing on thursday, awomolo call dia fifth and final witness, mr eee (no be im real name), who be officer of di department of state services. |
di witness tell di court say na im lead investigation into di impact of di end sars protest wey bin happun for across di kontri in october of 2020, and im be di secretary of di presidential ad - hoc committee on di assessment of impact of di end sars protest. |
e say im and im team bin travel to all di states for southern nigeria wia end sars protest bin happun and e document di public properties wey pipo destroy and di number of security personnel wey kpai during di protest. |
awomolo present to di court a copy of di report of di committee, and nnamdi kanu lawyers say dem get objection, but dem go raise am for dia written address. di trial judge, james omotosho admit di document in evidence. |
according to di report, a total of 128 policemen, 37 army pipo and 10 dss pipo bin die during di protest. also di protesters destroy a total of 164 police stations and 19 inec facilities across di kontri. |
as e dey give im witness, oga eee tok say dia investigation reveal say di broadcasts wey nnamdi kanu bin dey do ova di years, na im be di underlying cause of di insurrection. |
e say: "as a trained security expert, we know say evri insurrection dey get two causes, di one wey pipo dey see and di underlying cause wey pipo no see, wey be di main cause of di insurrection. |
during cross - examination, onyechi ikpeazu wey be one of nnamdi kanu lawyers ask di witness say: "so, di entire end sars protest na bicos di defendant ask pipo to protest?" eee ansa say im no know about dat but e know say di defendant bin don dey tell pipo make dem attack security officials and destroy public property... |
so when pipo bin destroy properties for osun and lagos state during the end sars protest, you dey tell di court say na bicos di defendant ask dem to do am? shey you dey categorically say di end sars issue na biafran issue?" ikpeazu ask. |
di witness respond say "my assignment no be to investigate biafra, my assignment na to investigate di end sars issue to which di defendant bin incite di public. |
eee insist say di issue of police brutality fit be di secondary cause of di protest, but di real reasons na bicos say some subversive elements bin don dey incite di public against di goment. nnamdi kanu broadcasts na one of dose underlying causes. |
di defense counsel den ask for a copy of di lagos state judicial panel of enquiry into the end sars protest, wey dem bin don tendered in evidence as exhibit pwo. |
e tell di witness say: "i put it to you say dis report no mention di defendant name or di ipob or to indict dem for di damages wey happen during di end sars protest." oga eee reply say im neva read di report so e no know wetin e tok. |
also during di cross examination ikpeazu point out to di witness some discrepancies for di document including say dem no give details of di dead bodies of di security pipo wey dem claim say ipob/esn pipo kill durin end sars, and di fact say neither di witness wey claim to be secretary of di investigative committee nor ... |
ikpeazu also point out to di witness say di part of di report wey concern oda states of di kontri, di title na 'report of di assessment of di damage of impact of di end sars protest', but from page 669 wey concern states in di southeast region, di title na 'report of di presidential adhoc committee investigating di act... |
i put it to you dat for di purpose of dis trial, una manufacture pages 669 downwards of dis document and den attach am to di report of the assessment of di damage of impact of the end sars protest," ikpeazu tell di witness, and e say "no, dat is not di case". |
afta di cross exmaination, fg lawyer awomolo inform di court say dem don exhaust dia materials for di trial as dem don call five witnesses and tender plenty documents in evidence, "we hereby close our case". |
di lead defence counsel, kanu agabi tell di court say dem intend to file a no - case submission. |
no - case submission na legal term wey mean to say di defence team dey tok say di prosecution no do enough to establish any case against di defendant, so make di court strike out di case. |
justice omotosho give both di prosecution and defence teams 14 days each to file dia written addresses, and e adjourn di matter to friday, 18 july, 2025, for adoption of written addresses in respect of no case submission. |
nigeria president bola tinubu don set up one committee wey go help bring peace for benue state. |
dis one dey come afta di killing wey happn for yelewata community inside guma local goment area of benue state, wia reports tok say dem kill about 200 pipo. |
national emergency management agency (nema) tok say thousands of people don lose dia houses sake of di recent attacks wey happun. |
Subsets and Splits
No community queries yet
The top public SQL queries from the community will appear here once available.